Cinema of Ghana, wey dem dey call Ghana Film Industry, dem nickname am Ghallywood,[1] Everything start when dem first bring film making enter British colony of Gold Coast (now Ghana) for 1923. Dat time, na only big men dem dey see de films, especially de white people wey be de boss for Gold Coast.[2][3][4] Film making for Ghana begin to grow for 1950 insyd.[5][6][7][8] Cinema be de main place wey people dey go watch film until home video cam turn popular pass am. Film industry no get official name yet secof dem dey consult den engage plus stakeholders wen dem send petition to Ministry of Tourism, Arts and Culture wey suspend de use of de name Black Star Films.[9]