Ameyo Adadevoh

Ameyo Stella Adadevoh (dem bon am for October 27, 1956 an e kpai for August 19, 2014) na Naijá doktor wey pipul no wel wel for wetin e du mek Ebola no kash meni pipul for Naijá. When Patrick Sawyer enta Naijá wit Ebola, Adadevoh bi di doktor wey trit an mek suo Sawyer no komot fom di klinik as Liberia Govament dey shaut sey mek dey rilis Sawyer for dem bikos e na dia pipul an sey Sawyer get one mitin wey e wan du. Doktor Adadevoh no gre bikos Ebola wey dey Sawyer bodi fit kash poblik pipul if e rilis mek e dey waka abaut.Adadevoh bi di fest doktor wey no let pesin wey Ebola kommot for Hospitu in Naijá an dis one mek Ebola no kash meni pipul in Naijá. For August 4 2014, Doktor Adadevoh sef kom kash Ebola an stat to tek tritment.Adadevoh dai in August 19, 2014.


From Wikipedia, the free encyclopedia · View on Wikipedia

Developed by Nelliwinne