Chude Jideonwo

Chude Jideonwo (dey bon am 16 March 1985) na Naija pesin wey dey tok for T.V, e na fim-meka, an na pesin wey sabi yuz intanet do bizness. Jideonwo join bodi tek form Red Africa and Joy, Inc, wey bi one Amerika organizeshon wey get ofis for Naija. E don wok for midiya ofis, ofis wey dey havatais.

Na Jideonwo bi pesin wey dey tok inside #WithChude tok show. E still bi di manija wey dey mek suo sey di show #WithChude dey hapun so dat pipo fit dey enjoin am. #WithChude na one program wey dey ask pipo kweshon to no di koko of mata wey dey hapun. Jideonwo still bi di pesin wey dey daret on program kol #ChudeExplains. #ChudeExplains na one program wey dey tok mata wey no go well for di envaromet an mata about kolsho. Jideonwo also dey among pipo wey form The Future Project. Dis The Future Project don help kampain for two Naija presidet an one One presidet wey de Ghana.

For November 2023, Dey pik Jideonwo to bi di presidor of TIERs. (The Initiative for Equal Rights).


From Wikipedia, the free encyclopedia · View on Wikipedia

Developed by Nelliwinne