Shif Pete Edochie, MON (dem bon am for March 7, 1947) na Naijá aktor. Edochie na one of Afrika most talented akto, an im don get plenti plenti awod laik Industry Merit Award by Africa Magic an Lifetime Achievement by Africa Film Academy. Edochie bifor na administrator an brodkasta but, na for 1980 wen NTA redu Chinua Achebe buk Things Fall Apart as fim, Edochie akt as Okonkwo for di fim na im mek pipu no Pete Edochie wel wel. Edochie kom fom Igbo traib of Naijá an na katolik e bi For 2003, President Olusegun Obasanjo gif am nashunal honor wey bi "Member of di Order of the Niger" ==Pasonal laif== Dem bon Pete Edochie for siti of Zaria wey dey norti of Naijá for March 7, 1947.Edochie selebret e 70 years biday for 2017 an e tok sey e stil dey strong.Edochie stil tok sey na to dey tek laif easi an dey plan wit purpos for evritin na im mek laif no taiya am as im dey old.