Phyllis and Aristotle

Woodcut Phyllis sit-down ontop Aristotle

Di tori of Phyllis an Aristotle na one tradishonal old tori wey pipo dey tok to fit advais man to dey kia-ful abaut wuman. Phyllis wey bi wuman yuz e fine faze an bodi tek kontro Aristoles to do wetin e want. Aristoles na one Greek filosofi man wey get sense wel wel. Phyllis an Aristotle tori na one of di popula tori wey show how wuman get pawa rish to fit kontro man. One of di tori vashon wey don tey na di 1220 French vashon Lai d'Aristote

Meni artists rili tok an rait abaut dis tori of dis wuman wey yuz sex kontro di man wey pipo sabi wel wel as pesin wey get sense pass from di 12 senturi . Dey draw di tori for stone wey dem yuz do chorch wall, dem draw am for kapet, dem draw am for glass an meni odas tins. Artist wey do somtin abaut Phyllis an Aristotle tori na Hans Baldung, Albrecht Dürer, Lucas Cranach the Elder, an Alessandro Turchi.


From Wikipedia, the free encyclopedia · View on Wikipedia

Developed by Nelliwinne