Skales

Raoul John Njeng-Njeng (dem bon am on 1 April 1991), dem sabi am for e wok as Skales, na Naija rapper an songraita. E kom Legos kon saign for Empire Mates Entertainment (EME) rekod label in 2009. Insaid 2000, e stat to dey rait songs rap songs for Kaduna, Nigeria. Na insaid 2007 an 2008, e travu go Jos to go wok wit Jesee Jagz an Jeremiah Gyang. Insaid 2008, e enta di Zain Tru Search Kompetishon an na im win di North Centra region own. Song wey e fest mek wey popula "Must Shine" , Rhythm Fm station pley di song wel wel for Legos, Jos an Abuja. Skales don di song wit plenti difren pipu lik Akon, ELDee, Tekno, Jeremiah Gyang, Banky W an Knighthouse. Som of di song we e sing wey dem sabi well wel na; "Komole", "Keresimesi", "Mukulu", "My Baby", "Take care of me" an "Denge Pose". Afta e komot for E.M.E in May 2014, e stat im own musik rekod label wey e kol OHK Music Record label.


From Wikipedia, the free encyclopedia · View on Wikipedia

Developed by Nelliwinne